MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 7 December 2015

E BE LIKE SAY HOSBAND NO EASY TO GET O,AS TOKE MAKINWA DON SETTLE WIT HER HOSBAND WEY GIVE ANODA BABE BELLE

Evriday naim i dey hia say hosband no easy to get,hosband no easy to get,but i dey tink say na odinari yarns.
Thru dis Toke Makinwa and Maje Ayida drama,naim i take know say to get hosband hard die.
Maje, Makinwa hosband,give him forma babe Anita Solomon belle some months afta dem marry.
Di babe don even born baby boy for Maje.


Dis wan kon make di marriage crash like pack of cards as Toke vex live di bobo even tho di bobo dey begam since.
But yestaday,tori pipo shock to see dem two for di Future Awards wey appun for Lagos yestaday as dem kukuma conclude say dem don settle bi dat.
Dats why e no good to chook mouth for hosband and wife mata bifor dem go use u take settle for bedroom.
Make una come back kon check di latest for dis tori.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...