MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 5 December 2015

YEYE SHAKARA AS TIWA SAVAGE DON SHOW FOTO OF HER PIKIN LEGS AGAIN

Wetin Tiwa Savage and her hosband dey feel like?
Dem born boy pikin,dem kon dey use dia fans dey play ten ten.
Imagine,since dem born dat pikin,dem neva show di baby face.
Today dem go take am foto and show only di pikin hand.
Sometimes dem go show di pikin ear.
Now yestaday,na di pikin legs Tiwa show us for Instagram and her fans nor hapi wit her karata as dem bigin pourram curse.
Oh! so na by force to form Kim Kardashian and Beyonce?
Naija pipo dey see beta pipo face nor be dis expired shakara.
No be dia fault but make dem remember say,no mata how wood float rich for riva,e can neva turn crocodile.
No mata how dem do am rich,dem can neva turn Michael Jackson.
Make dem Gerarahia jor!
Okoro pipo wey dey feeli funky.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...