MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 12 December 2015

TB JOSHUA NA Di YORUBA MAN OF Di YEAR AKORDIN TO 'EGBE OMO OODUA PARAPO'.

For dis life,nor be evribodi must like you or like di tins wey u dey do.
And if one pesin dey wey fall for dis catigori of pipo,dat pesin na di owna of Synagogue Church of All Nations, TB Joshua.
Some like am why some nor like am but one group wey about 35 groups join muscle togeda form,'Egbe Omo Oodua Parapo',don name TB Joshua from ova 500 names wey di planning comiti skrin as di "Yoruba man of di year" akordin to Dr Akinwale Adewunmi, the Chairman of di award comiti.


During di joinbodi meeting for Amerika,Dr Akinwale yarn say,TB Joshua dey give di yoruba nation beta levels base on di gud gud tins wey hin dey do for pipo all ova di world.
He say dem dey proud of am say na Yoruba man him be.
He also yarn say,TB Joshua good work evri year,dey ova 45 kontris and e no send yor religion or language if time to hep don rish.
He say di pastor start life as a poor boy from a poor home for Ondo state.
He nor go skul or get one singo hep from him comuniti but he stil fight and make am by imsef.
Akordin to Dr Akinwale Adewunmi, TB Joshua take imsef go skul and today na profesor for di greater univasiti of life and living.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...