MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 28 December 2015

DON JAZZY SAY HE GO RETIRE FROM SINGING WIT HIM FROG VOICE FOR 2016

Don Jazzy don yarn on top twita say,na to retire from singing by 2016 naim dey he mind.
How old Mavin boss Don Jazzy be wey he won retire from singing?
For real life,u say u neva rish 40 not to talk of yor football age.
Beta produca naim you be,I nor fit ask queshon for dat one but di singing sef kon inkriz yor GP.
If pipo nor love yor frog voice like dat,yor GP nor go dey wia e dey today.
Michael Jackson sing til he die at di age of 50, he nor retire.
Quincy Jones dey conduct,dey produce,dey arrange,dey compose,dey act,dey sing dat year and he neva stil retire at di age of 82.
Na only betday Quincy dey celibrate,he nor dey celibrate retirement.
If you retire who knows, one Don Quazzy fit spring up and take yor place and if u try to do singing comeback,pipo fit nor send u again o!
I know naija pipo o! Dem get bomb for head o.
Dem neva stil ansa Mocheddah,Olu Maintain,Mandators,Kelly Handsome and many odas afta dia comeback songs.
Ehen,I just dey yarn sha.
Make dis my smelling mouth nor land me for trouble o.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...