MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 7 December 2015

KPOKO!!!E BE LIKE SAY LINDA IKEJI DON DEY ENGAGE AS SHE WEAR ONE SHINEE SHINEE RING

From wetin i dey see so,e be like say tori queen,Linda Ikeji don dey engaged.
E be like say one bobo don put ring for inside o.
Linda attend di Future Awards wey appun for Lagos for wikend and from wetin i dey see for dis foto wey she take,engagement ring dey dat finga.
Abi na joke?bicos some gehs dey carry wia ring for any finga dem like o.
Some dey even enta market go buyam to pose make dia levels for rise.
For sometime now,fans no dey allow Linda Ikeji rest again as dem always dey worry am say wen she won marry even wit her plenti money?
About 3months ago,Linda shock crowd wen she buy one wicked bunk of about N500m for Banana Island for Lagos.
Wit dis ring for her finga,weda na joke or na for real,we go soon find out.

Time go tell.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...