MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 3 May 2016

NA LIE! PEPSi SAY DEM NEVA SACK TIWA SAVAGE, DIA FRENDSHIP STILL STRONG KAKARAKA


Nor be small tin appun last Thursday bitwin Nigeria singa, Tiwa Savage and her forma hosband Tunji Balogun a.k.a Tee Billz as two of dem reliz sikrits of dia marage ploblems for poblik.
Dat dia fight brake record on top YouTube sef as one di tori wey spread fast like strong briz for hamatan.
Tank God say di kain jonalist work wey we dey do for 'Ogakpatakpata', nor be to lie or form tori wey nor dey exist.
Some tori pipo bin carry tori say, Pepsi don sack one of dia ambasador,Tiwa Savage.
Wen dis kain tin disgrace appun sha,di konpini or konpinis wey take u take do dia pasona pesin,so dat u go dey front dia product as a star,fit sack u as dia ambasador.
But Pepsi don come out now say,na heavi lie if anybodi tell u say dem don remove Tiwa name from di list of selibritis wey dem giv rite to carry dia mata for head like lakpalakpa.
Di soft drink konpini say dia frendship wit Tiwa Savage stil dey kankpe,E stil strong kakaraka,inshot dem say dia frendship na 5 and 6.
Pepsi yarn all dis one on top twita so dat me and u go know wia dem stand for di rumor wey dey spred like smoke for town.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...