MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 7 May 2016

I NOR GET ANY BIZNESS WIT Di REGGAE MAFIA,MAJEK FASHEK AGAIN - AYIRI EMAMI



Notin last foreva,na so dem talkam.
Di brodali love and frendship wey Warri billionaire,Ayiri Emami and reggae legend,Majek Fashek,dey enjoy since last year,don finalli hit rock.
Ayiri tell tori pipo say since di day wey Majek travel to Lagos against hin wish from wia he for dey take tritment for Abuja,na dat day he comot hand for di guy life.
If u rememba,Majek bin get ploblem wit him life as small skoinskoin kon enta him head.
He kon dey beg ogogoro waka and tins kon hard for di reggae mafia.
Na Ayiri naim later reskiu Majek as he carry am go Abuja and pay di hospita wey tritam.
Akordin to Ayiri,di doctors say make Majek stil rest small bifor he enta town but Majek blood dey hot as he run enta Eko go paform for felabration for Africa shrine.
Majek imsef don yarn for di mata as he say Ayiri sopose to know say him na America-train miuzishan but Ayiri won tritam like Nigeria miuzishan.
Majek say e nor fit work like dat even tho he claim say dem be stil veri gud frends.
Bros Majek,I hope say nor be mistake u dey make so?
Ayiri money long like 3rd mainland bridge and you for stil nidam to take dey plasta mata for now.
We dey watch una.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...