MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 13 May 2016

FOR WHAT NA! TINUBU SAY MAKE WE BEAR Di SOFA WEY Di FUEL PRICE iNKRiZ GO BRING


APC nashona lida,Bola Tinubu,don yarn anoda one,afta Buhari and he boys inkriz di price of fuel.
Tinubu say make naija pipo bia di pains bicos e go favor us afta.
Dis one na anoda stori for di gods.
Na di same tin wey we hia for Goodluck regime be dis.
I rememba wen Okonjo Iweala yarn dat time say,dem go turn Nigeria to heaven for six months afta dem inkriz fuel price.
Dis pipo nor dey fear God sef?
Di APC lida,Tinubu say,many pipo don turn billionaires ova nite sake of say we dey inpot fuel but dis inkriz of fuel price go stop dem.
He say na lie him dey lie if he tell u say,he nor know say dis N58 wey dem put on top fuel,go make pipo sofa like mad.
Bola Tinubu say make we nor worry tins go soon pick up.
Yeye dey smell pipo evriwia.
Anybodi wey say naija nor go beta,na mamiwater go givam poison drink for hin sleep.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...