MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 8 May 2016

WIZKID DON SHEV NAIJA MIUZISHANS AND SIGN THREE GHANA MIUZISHANS FOR STARBOY RECORDS


Di two pipo wey we know for Starboy Records bifor, L.A.X and Maleek Berry names nor dey among di ones wey Wizkid announce last nite afta he win di Africa artiste of di year for Ghana miuzik awards.
Di ogakpatakpata of Starboy Records imsef,Wizkid name Efya,R2bees,Mr Eazi and imsef as di pipo wey go carry di new Starboy Entatayment Worldwide logo for head.
All of dem na from Ghana and I kon bigin to wonda weda L.A.X nor dey among di gang again.
L.A.X naim be Starboy first artiste and from wetin we undastand now,hin two years kontract from 2014 to 2016,don end.
Maleek Berry own dey clear as na produsa dem signam as bifor but Wizzy nor yarn anytin about am too.
We stil dey wait to hia more tori about wetin dey wida as Wizkid also use di opotuniti to beg Africa to soport dem foreva and not only today.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...