MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 10 May 2016

KCEE DON YARN SAY,EVRITIN WEY HIM LOST,HE REKOVARAM THRU LIMPOPO SUCCESS

Life get too many stori wey go make u know say,nobodi know how God dey do hin tins.
Espeshali wen tins first roff and kon later dey swit.
U don get yor stori to tell us?
Kcee don tell us hin own,of how God take turn him life around afta he reliz dat Ogbonge song,Limpopo wey skata many pipo dada for outside and inside dis kontri.
Akordin to Kcee,he say,him do seven songs afta he go solo from dia group,Kcpresh.
He sing Opekete,pipo nor sendam,he sing anoda one,Give it to dem,pipo block dia ear.
He say as he reliz Limpopo,naim God pasonali take charge of pipo ears as dem fall in love wit di song.

Five star miuzik artiste Kcee say,di success of Limpopo don make am rekova evritin tin wey him lost inkluding di time wey him waste for furniture bizness.
He say he own famili pipo also join telam say he nor sabi sing make he kpror for wia kontain am.
But today,na halleluyah tins since Limpopo show face.
Di bobo kon throw one Ogbonge advice to evribodi wey dia hussle neva pure say,make dem biliv in diasef and neva giv up.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...