MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 3 May 2016

CONFAM: Di NEW BEYONCÉ NA FROM AFRICA





Sometimes I nor dey know how to diskraib God and di way wey He dey work.
Jehovah nisi you to bam bam.
All di bammest soprises for dis world na from God.
Anybodi wey dragam,blow tools for hin face.
And anybodi wey judge any book by hin kova,arrestam fast.
Wen I watch dis 18 year old girl vidio of how she take sing America supastar,Beyoncé song,Halo,I shout!
As u dey read dis stori,i stil dey shout as  my koligs for office dey plan to tie me wit rope bicos dem dey feel say I don dey kolo.
Na confam Africa Beyoncé dis babe be.
Her name na Audrey Iteriteka from Burundi.
I nor soprise say Lil Wayne shawa praises for Facebook on top di girl head.
Di bad tin about dis girl life be say she nor get papa,she nor get mama again as two of dem don die.
She dey study modern literature for t Lycée Sainte Theresa Gitega for Burundi.
Nor be say she even take dis miuzik bizness sirios bifor as she dey sing just to entatain hersef but today her stori don dey krip small small enta di world as dem don diskraib her alreadi as di biggest miuzika talent wey Burundi don eva see.
Goodluck to you Africa Beyoncé.
Di world dey wait for you.

Klik and Watch di babe as she dey sing Beyoncé song,Halo


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...