MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 14 May 2016

NEW MILLIONAIRE AND FORMA BREAD SELLER OLAJUMOKE,DON GIVE 5K EACH TO HER FORMA FELOW BREADSELLERS


One of di most lucky human being for di world,Olajumoke Orisaguna,di forma breadsella wey don hama since luck shine on am,don go back to her forma bakery and she dash her frends wey she dey hussle togeda wit bifor,5k each.
Many konpinis like Payporte,Shirley Confectionaries,Stanbic Banks and more,don use her take do dia ambasador and dia pasona pesin.
Dis kain frendship wit dis kompinis don inkriz her bank account.
Four months afta Olajumoke breakthrough,she don dey giv back to di sosaiti and na veri gud tin be dat.
God say give and u nor go lack.
I hope say her manager go manage her well now wey she nor dey lack.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...