MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 2 September 2015

FORGET WETIN YOU DEY THINK,ME AND RIHANNA NA ORDINARY FRIENDS - LEWIS HAMILTON

Propati of di fast track and car racing,fomula 1 driva,Lewis Hamilton,don dey tell evribodi wey care to listen say,him frendship wit Rihanna nor be wetin pipo dey tink.
For sometime now,na di bobo and Rihanna dey hang out pass.
Dem hang out for New York and Barbados togeda of recent and many pipo dey xpect dis two big names to anounce say somtin dey pipeline.


Last mont,dem two dey togeda like bread and butter for Rihanna kontri,Barbados during di annual Crop Over Festival.
Lewis Hamilton say,even tho say dem dey chill togeda evri now and den,dia bodi nor dey enta magnet mode.
No shaking,i go dey siddon dey watch to bring una tori about dis two celebriti if dia mata later tie wrapper.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...