MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 7 July 2016

DAVIDO DEY THREATEN TO CANCEL HIM KONTRACT WIT SONY MIUZIK INTANASHONA,IF DEM NOR DO SOMETHING ABOUT HIM KARIA


Di rumor wey dey rich our table now be say,Davido don dey tire for di kontract wey hin sign wit Sony miuzik as di bobo fil say dem sopose to don reliz hin album.
Apart from di album delay,he fil say dem nor dey do enuff to push hin miuzik enta America.
Davido blood too hot sef.
E be like say Davido nor undastand how dem dey like run shows for yonda.
Dem nor dey rosh,dem dey take am jejeli.
Well,some pipo don dey yarn say dem undastand why Davido dey hurry.
Akordin to some pipo wey I folow yarn,dem say why hin blood nor go hot wey Wizkid don blow for di world espeshali for America.
If na only blow Wizzy blow,e for gud.
Di bobo miuzik dey brake rekord and top chart for yonda.
Like dis,like dis,na America naim Wizzy dey stay now.
Sorry Davido,take am easy.
Life na turn by turn.
Many pipo dey pray to achiv wetin u don achiv at yor age.
If u valiu wia God don push u rish,you go kamdan.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...