MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 10 July 2016

QUARREL DON START AGAIN AS PAUL OF PSQUARE PAFOM ALONE FOR CONGO BICOS PETER REFUSE TO GO


Bifor,we bin tink say Psquare kworel na skamin but afta wetin appun dis week wen Peter tell di oganaizas of dia Congo show say,him nor go atend di show,na now we don know say all dis dia kworel na real kworel.
Di last time Peter talk say,dia sinior broda and manager wey be Jude,must stop to be dia manager  for peace to reign.
But dem settle dat one.
Now Jude don book show again and fresh gbege don start.
Afta Peter say him nor know about di Congo show,video evidence show say,na lie he lie bicos he even join Paul promote di show for di vidio.
Watch di vidio evidence for botom hia..

Last nite,na only Paul pafom for di show for Congo and he reliz pichors and vidio of hin pafomans for di show and he nor
Di tin don too much.
Make dem kuku brake up make dia fans rest.
Dem go kworel,dem go settle,dem go kworel,dem go settle.
God sef go don tire for dis dia kworel.
If u ask me,I biliv say dis na di end.
Maybe di next tin wey we go hia now go be,dem won share propati.
Watch Paul solo pafomans fo botom Hia...





No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...