MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 10 July 2016

POLICE DON ARREST UGANDA MAN WEY DEY CLAIM TO BE 'JESUS' AND DEM ALSO ARREST HIM 9 DISCIPLES


Jesus Christ of Nazareth!
Jesu!
See tori!
One Uganda man,Emmanuel Solomon Ssemakula wey also get 9 followers,don enta police net as police don dey readi to carry am go court bicos he dey claim Jesus.
Nor be only dat,dem say he also get case to ansa bicos he advice him folowas make dem nor dey go hospita if dem dey sick.
Wen dem dey sick,dia own na to pray to dia Jesus for healing,notin like hospita.
Police say dat one na crime bicos he dey tell pipo make dem avoid gofment programs like hospita.
Dis Uganda Jesus nor even dey shake as he stil dey tell tori pipo for police station say,naim be Jesus and dem bornam for Jerusalem.
Him folowas don dey witam for six years now and dem say,dem biliv say dia lida naim be Jesus true true.
He say hin mission for di world na to select di 144,000 pipo wey go enta haven bifor hin papa second coming.
Na wa for dis mata o.
I for advice police to free dem and make gofment gidem clothes,food,pocket money and also gidem work.
Hunga bad.
Watch di vidio of Uganda Jesus for botom Hia...






No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...