MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 10 August 2015

GOVERNOR OSHIOMOLE DON SWITCH FROM KHAKI TO DESIGNER SUITS SINCE HE RE-MARRY TO Di BIUTIFUL GIRL FROM CAPE VERDE


If u neva hear "Strenght of a woman",dat song wey Jamaica born reggae miuzishan Shaggy sing,abeg try go hearam.
For dat Jam,Shaggy praise woman finish and tell us about di power wey dem get to take run tins and how impotant dem dey for man life.
Check di life for Bible of di strongest man for di world many years ago Samson,na Delilah make dem barb him dada and na dat dada all him power dey.
Put dat Shaggy song here and put Oga Oshiomole here,e go be like say na bicos of am di bobo release dat jam.
Di forma NLC presido and Govnor of Edo state,Adams Oshiomole don stop to wear khaki uniform wey dem take know am for ova 15 years since he marry him sugar peperenpe,Lara Forte from Cape Verde.
U know say dat khaki dey carry ranks for di shoda of di shirt.
Levels don real change.
Now, na koret koret designa suits Oshiomole dey nod.
I don dey study di action govnor for sometime now and i neva siam wear anytin like khaki again.
Abeg make we join hands clap for Lara Forte of Cape Verde,di woman wit plenti strenght.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...