MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 4 August 2015

2FACE DON YARN SAY NAIJA NUMBER ONE MUSICIAN NA FROM MUSHIN

E get some kain praise wey go make yor head swell and if dat praise no make yor head swell,naim be say boil catch yor head dat piriod.
If dat praise kon come from pesin like 2face, di ogbonge legend for African miuzik,naim be say u get enjoy dat moment.
Wande Coal,di "from Mushin to Mo hits star",don get beta praise from 2baba imsef for twitter.
2face yarn for twitter say,na Wande Coal be im best Nigeria miuzishan right now.He say di boy good die.
2face imsef don get plenti praise too but most of dem come in di form of awards.
Upon all dis praise,2face and Wande Coal neva do any colabo togeda and pipo don alreadi dey guess say, two of dem don dey cook somtin for studio but dem neva know wen e go don.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...