MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 16 August 2015

SIKIORITI AGENTS SAVE TIMAYA FROM WADO-WADO BOYS AFTER HE PAFORM FOR BAYELSA APC RALLY.

Bayelsa state son of di soil Timaya,nor go forget wetin appun toram in a hurry wen he go paform for di APC mega rally for him state of orijin.
Dem say dog nor dey chop dog but wen dog decide to chop dog,naim be say water don pass garri be dat.
Afta Timaya paform for di rally and he won remove,di policemen for di veniu wey dey around to provide sikioriti,escort di politicians comot as Timaya kon dey xpose to wado wado boys(obtainers or pocket pickers).
As some good samaritan yuts try to escotam,some bad ones kon join to obtain di egberipapa1 of Bayelsa bicos dem feel say he sopose settle dem.
As Timaya see say di mata don pass bi kiafu,naim e put him gold chains,phones and oda impotant tins put for pocket.
Na God save am as pipo wey dey oprate di Department of State Security (DSS) notice di way wey di wado wado bois dey harassam.
Dem kon spray tear gas to drive dem away as dem later escot Timaya from di stadium thru anoda gate.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...