MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 9 August 2015

AYIRI DON CARRY MAJEK FASHEK GO HOSPITAL TO FLUSH ALL Di NYAMA NYAMA FROM HIS SYSTEM




Do good today and good go dey follow u evriwia u go.
Akordin to di tori wey enta our office,Warri bigest boy,Ayiri Emami naim dey sponsor Majek Fashek tritment for di Abuja hospita wia dem dey re-arrange pipo wey drug don do strong tin to dia brain.
Ayiri also dey pay to bring xpat wey dey trit dis kain drug wahala all di way from obodo oyibo to make sure dem giv Majek koret tritment.
For sometime now,one of Africa goodest reggae miuzishan,Majek, don dey get dis problem sotey,he dey veri broke to take care of imsef and he dey even dey beg to buy ogogoro for street.
We dey wisham good tritment wey go bringam back to beta life again.
Nice one Ayiri Emami,di Akulagba 1 of Warri.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...