MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 11 August 2015

TEE BILLZ DON TAKE OVER Di KITCHEN AS HE ARRANGE WACK FOR TIWA SAVAGE AFTA SHE BORN

Di best hep wey man fit give to him wife wey just born,na to hepam wit all di haus activitis wey di woman dey do wen she neva carry belle.
Yor wife go love u more,pipo sef go call u beta husband.
For example,enta kitchen and dey cook for her,sweep di haus and mop di floor evriday,remove all di cobweb wey dey design map of Africa for yor wall,wash her clothes and una pikin clothes,also make sure u dey wash all her kpata.
if una don get any pikin bifor,bafam evri morning and prepiaram for skul,if yor wife no love u 100% more,naim be say u marry di wrong pesin.
Right now,naija top miuzishan,Tiwa Savage husband Tee Billz, don start to do haus work for him wife.
Tiwa Savage diliva a bouncing baby boy July 22 for St. Mary’s hospital for London and Tee Billz don start to do some of di kwekwe job for haus.
Tee Billz post di pishor for instagram of wia he for dey arrange wack for him darling wife.
He say di wack name na,"Grilled Chicken Breast Salad.''
Check out di pishor  for yorsef.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...