MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 31 August 2015

BURNA BOY AND CYNTHIA MORGAN DON ENTA MAGNET, AS DEM DEY KISS DIASEF

E be like say Cynthia Morgan don dey give fellow reggae and dancehall star,Burna Boy dat German juice wey she dey tell me about.
You no need any oracle or ifa priest to tell you say somtin dey pipeline xcept say pishor dey lie.
Cynthia Morgan post pichor of wen two of dem join dia mouth like magnet,kon dey kiss,dey kiss,dey kiss,like say dia life depend on am.
She kon even fan di fire wen she write on top di foto say,"make we talk truth,make we dey real."
E be like say na Burna Boy she dey tell say make dem stop to lie,make dem yarn di world di truth say dem dey pin demsef down.
Some weeks ago,wen tori pipo from Mtv Base Real talk show,ask Burna Boy who him go like to tap bitwin gentle Chidinma and fire ting Cynthia Morgan,di bobo choose di German juice owner.
He also give dem quik ansa say two of dem (gentle and fire), go good for beta meal too.
Also some weeks ago too,Cynthia Morgan say she nor fit frend any Naija celebriti bicos dem poor pass church rat.
I go siddon for fence dey watch di new tori wey go come out bitwin dis two pipo and  I go dey watch too weda na me or na una dem dey fool wit dis foto.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...