MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 14 August 2015

NOLLYWOOD ACTOR PAWPAW,GET TRANSPORT LINE AND DON ALSO DEY BUILD HOTEL(fotos)

Some days back,big name for home vidio, Osita Iheme a.k.a Pawpaw,bring out pishor of one of him transport motor wey get bad accident and promise say dem go replace am veri soon wit new one.
And he also use di oportuniti to tank Baba God say nobodi die for di accident.
He say dem dem lost money but no life lost.

Just yestaday,di bobo post anoda pishor of di hotel wey him dey build for instagram and for di pishor u go see pipo wey dey work and carry konkray.
Na koret sense Pawpaw get so bicos many nollywood stars, afta sometime, we go hia say dem don poor bicos dem no save and dem no invest.
As di mata be so,kpatakpata if e red for Pawpaw,he go fall back to di moni wey all dis investment  dey bring.
Dis na koret tin for me and u to len from.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...