MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 17 August 2015

I DEY MISS MY FRIEND M.K.O ABIOLA - IBB

Forma khaki presido, Ibrahim Babangida,don yarn say he still dey miss him late friend,Moshood Abiola wey die for jail on top say he win di June 12,1993 election wey Babangida imsef cancel.
Akordin to tori pipo and evribodi wey monitor di election dat year,dem say na di best election wey dem don eva oganize for naija sake of say no wuruwuru and no magomago for di result.
IBB wey dey celibrate him 74 years old betday today, yarn dis one for one join bodi siddon  for Minna,Niger state wit tori pipo as he dey ansa all di queshon wey dem askam.
Wen dem askam weda he miss him frend,MKO Abiola, IBB ansa dem say, just last week here naim he uproot and read one of di letas wey Abiola write toram and dat one show say he stil dey missam.
But many pipo go stil argue say dem no see how he take be beta frend to Abiola bicos na since he cancel June 12 election naim di man life take anoda turn and na ontop say Abiola talk say naim must be president naim Abacha putam for prison.
Inside dat same prison,naim MKO take kpai.
We stil dey xpect to hia from Abiola famili weda IBB na rili him true frend.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...