MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 5 August 2015

SNOOP DOGG CARRY GHANA MUST GO BAG DEY WAKA FOR STREET

If u feel say di popular Ghana-must-go bag na only naija dem for dey siam buy,u dey deceive yor sef be dat as Yankee rappa,Snoop Doggy Dogg don show for dis pishor say no be our pasona propati.
From all di 14 kontris wey i don visit for obodo oyibo,i don siam for at least five kontris.
Snoop bin carry N85,000,000million cash for im bag as he  won enta plane comot from Italy afta show but di airport authoriti sizz di moni sake of say na only N2.5million cash naim u get right to carry waka.
Alltho dem giam haf of di moni back but akordin to di law for Italy,dem go fine am bifor dem go giam di rest as hin lawyer talk.
Akordin to di lawyer,Andrea Parisi,he say no be crime,na just management problem and di moni na di moni wey Snoop gada from all di shows wey he dey do across some Europe citis to promote im album,"Bush" wey he reliz earlier dis year.
Rememba say last week afta one of im show for Sweden,dem arrest Snoop sake of say dem won check weda ganja dey im system.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...