MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 7 February 2016

ZARA,DI BABE WEY GET BELLE AND BORN FOR BOKO HARAM MEMBA DON YARN SAY SHE DEY MISS DI BOKO HARAM GUY LOVE BADLY

Zara John,di 16 year old geh wey Boko Haram kidnap dat year,don yarn say she dey miss one of dia memba wey giam belle.
Afta naija army reskiu her,her family membas kon dey konfiuz as some say make she do abortion bikos dem nor want pikin wey go be bastard.
Di pipo wey say make she livam naim plenti pass.
So she kon born di pikin wey dey 7months old now.

I nor know why she nor tell di sojas wey reskiu her say make dem live her wit her Boko Haram frend.
If dis kind geh fit see her pikin papa again,I hope say,if dem send her go suicide bombing,she nor go go.
Na so e take dey start.
Pesin wey love terorist go readi to go any mesage wey di terorist go sendam.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...