MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 1 February 2016

KING WIFE DON ENTA ONE CHANCE FOR UDUMUJE UGBOKO FOR DELTA STATE AS DEM DON DRIVE HER FROM PALACE BICOS OF KUKERE WAKA

Oba nor dey go transfa as dem talk am but Queen Okwukwe Nwoko,di wife of Obi Agbogidi Nwoko 111 of Idumuje Ugboko Kingdom,Aniocha north,Delta state,don get transfa to comot from di palace bicos of kukure waka.
Akordin to di mata wey dey ground,dem say she dey waka pionpionpion go find man.
Dem even akiuz her say,nor be di Obi givam belle of her three year old dota.
Well,I hope say nor be bikos di Obi na 90 years naim make her dey shook leg for outside?
Well,I just dey ask sha.

Di main pesin wey dey giv di Queen headache na,di Obi son,Prince Nonso Nwoko bikos he nor won see di woman for di palace.
Nor be only di kukure waka be di problem o,dem say dem also catch her dey watch blue film for inside palace.
Wey dem gada all dis tins togeda, naim dem drive am from Obi Agbogidi Nwoko palace.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...