MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 17 February 2016

PSQUARE WAHALA: PETER OKOYE DON YARN SAY,NA DIA SINIOR BRODA,JUDE,BE PSQUARE PROBLEM NOR BE EEN TWIN BRODA,PAUL


Wen dusting powder nor dey pepper you again for bodi afta sometime,make you know say di powder power don dey reduce.
Now,di tins wey fans don dey notice for sometime now about Psquare don dey show een ugly head.
If u notice,Peter don dey do some kain bizness alone like 'Dance with Peter and he also form one football management compini.
Also,een twin broda,Paul don launch een own record compini,Rudeboy Records and for ova two weeks now,he don dey waka dey promote Muno,di first artiste wey him sign.
Rudeboy records don dey create awareness from one radio station to anoda for Muno since last month.
Di koko now be say,wen u put all dis tins togeda,pipo don dey smell say Psquare won brake up.
Dat na if dem neva brake up alreadi.
Peter Okoye don come out on top twita yarn say een biliv in Psquare 100% and him nor get any problem wit Paul but na dia manager be dia problem.
Jude,dia sinior broda,naim be dia manager for years now and we dey wait wetin een go yarn for dis mata.
If u rememba for 2014,na small tin make Psquare nor break up afta dem get kwanta.
Bicos of dis kwanta,Jude and Paul nor gree attend Peter traditiona marriage dat piriod.
Sake of say blood dey tika dan water,dem kon settle but now,we go sidon dey watch how dem go solve dis one dis time around.



No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...