MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 16 February 2016

CHIEF ZEBRUDAYA DON YARN SAY,GOVMENT NOR FIT DO HALF OF DI TINS WEY T.B JOSHUA DEY DO FOR MOST OF DEM


One of di pipo wey make drama swit in dose days,Chief Zebrudaya,don yab gofment sake of say dem nor send entatainas for dis kontri.
He say instead,oda kontris naim dey show dem love.
He yarn all dis one during one join bodi sidon to take lunch one new film, 'I believe' for Abuja.
Chief Zebrudaya wey be di nomba one face for di Tv drama, New Masquerade for televishon plenti years ago,say him nor dey soprise bikos nobodi send prophet for een own town.
He say na di gofment of Gambia give 18 of dem plot of land for dia GRA off resent.
Gambia gofment use di land take aprishiate wetin dem dey do.

Akordin toram,dia gofment say nor be only naija dem dey giv gud name but di whole Africa.
Zebrudaya say even futbolas dey sofaram too and na only T.B Joshua dey use him church mind dey do gud.
He say if T.B Joshua won honor you,he go give u one million plus car and di whole Nigeria gofment nor fit do dat kain tin.
He say if dis govment pipo won do any joinbodi meeting,na dem go stil entatain dem but yet dem nor won do anytin for di entatainment industri.
Sorry Oga Zebrudaya,uncle Jona carry one heavi money give una.
Na some of yor pipo chop di money alone.
Na dis one make Mr Ibu swear last month say, anybodi wey chop for inside di money go die.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...