MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 10 February 2016

PAUL OKOYE OF PSQUARE DON YARN SAY,E PAIN AM ENTA BONE SAY DEM NOR SIGN 9ICE,PHYNO,KISS DANIEL AND PLENTI ODAS

Paul Okoye say bicos dem dey do dia pasona bizness nor mean say Psquare nor be one famili.
Since he start een own rekord label,Rudeboy Records,he don sign Muno bikos he no want make di mistake wey him and him brodas do bifor,repit esef.
He say wen dem bring Muno kon givam,him rosh signam bikos he nor won hear tori say di boi blow tomorow and him don miss again.
He say na so dem take miss 9ice,Phyno,Kiss Daniel and plenti odas for Square records.
Paul Rudeboy say wen he first say make dem sign 9ice,evribodi like am o,but dem dey work on dia 'Do me' album dat time.

He say him also regret say dem nor sign Phyno for Square records.
Di bobo say di first pesin wey him for sign for Rudeboy Records na Kiss Daniel bicos as he hia woju for radio,naim he call Kiss Daniel but to signam nor work out.
Paul say even Cynthia Morgan na Square records sopose signam.
Akordin to Paul,wen dia sinior broda Jude,bring Cynthia Morgan,im soportam but een twin broda,Peter nor too like di idea.
Bicos Jude nor won hia storis dat touch again,naim he carry Cynthia Morgan folow bodi enta him pasona label,Northside Records.
Paul Okoye right now dey carry Muno waka from radio to radio dey promote di bobo new songs,'No regret and Slow Slow'.
Paul also yarn say Psquare go reliz two or three songs for 2016.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...