MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 11 February 2016

BETA CHANGE DON SHOW AS SENATOR BEN BRUCE DON GIVE ORDER SAY MAKE DEM DEY SELL 'MADE IN ABA' GOODS FOR SILVERBIRD SHOPS


E be like say na true say Nigeria go beta one day o as di common sense senator,Ben Murray Bruce dey show us say him na lida wit diferens as he don carry naija betament for head like lakpalakpa.
As di owna of Silverbird nationwide,he say veri soon all silverbirds shops go soon get space to dey showcase and sell made in ABA goods.
He don dey yarnam for sometime now say make we try dey soport our own tins.
You get to start to like dis man no mata how u see di mata.
Even most of silverbird cars and buses na made in Nigeria.

Made in Naija motor wey silverbird dey use

One of di pasona pesin of ABIA state govnor,Mr Sam Hart,wey dey reprezent dia govment for di Made in Aba trade fair wey dey appun for Abuja,naim dey update us.
He say Ben Bruce don gree to allow dem dey sell made in Aba products for all Silverbird nationwide.
If e reali appun,na to klap beta klap for Ben Bruce naim remain.
We dey wait.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...