MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 8 February 2016

BETA SELFIE: WETIN OMAWUMI AND WAJE TAKE WASH DIA TEETH FOR DIS FOTO?

Dis pishor wey dis two songbirds,Waje and Omawumi take,nor be here o.
E make sense die.
Di hapi mood,na somtin wey dey buss my brain.
Wetin even swit me for di pishor,na dia teeth.

One of my writa,Egwonor,say,e be like say dem rob chalk for teeth naim make dia teeth white like dis.
Lol.i nearli biliv bikos I rememba my primary 4 tisha kola teeth.
Di man dey use like five Close up and seven Maklin for one week and e teeth stil brown pass Bobby Brown shoes.
I nor biliv Egwonor sha bikos my niece,Patricia teeth white like dis too.
Anyway,chalk or no chalk,di botomline be say,I just like di spirit behind di foto.
I wish say pesin fit just dey look hapi like dis evritime,e for nice.
NEPA sef kant gree us not to talk of hunga.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...