MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 13 February 2016

DIS NA YAWA CHANGE AS OYO STATE GOVNOR DAUGHTA,ABISOLA,DON NACK N15 MILLION NAIRA WRISTWATCH FOR HAND






Buy N15m fatalaiza for farmers make dem use for dia farm.
If dem harvest wetin dem plant,dem go get gain of ova N30m.
Na all dis kain sense our lidas sopose to dey use dey rule dis kontri.
Now,wia Abiola Ajimobi di Oyo state govnor pikin for see 15 million take buy wristwatch?
Abisola Kola-Daisi,di dota of di govnor show off her wristwatch on top Instagram and na Chopard product.
Chopard,na made in Switzaland expensive watch and akordin to di tori,dem dey sell di one wey she wear $50,000 wey be N50million for naija money.
Wia she for see dat big money take arrange dat kain watch?
Abi na di compini wia she dey work buyam foram?
See as I dey yarn sef!
You don hear bifor say our lidas shidren dey work?
I nor doubt di price of di watch bikos yestaday,Davido yarn us say two of een wristwatch go buy 20 cars.
If na dis one be di change wey dem dey tell us about,abeg baba God, unchange am.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...