MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 15 February 2016

FLAVOUR DON TURN AFRICA MICHAEL JACKSON AS ONE BABE FAINT FOR ABIDJAN AFTA SHE HUG FLAVOUR


E be like say naija biggest music fans na Ivory Coast dem boku full.
Why I nor go yarn like dis wen e be say na so so faint dia babes dey faint for our miuzishans.
One just faint for di capita,Abidjan last week for Flavour Nabania afta Flavour hug her.
Na Flavour yarn dis one on top twita and he say him tank God say di babe don rekova from di fainting.
Nor be di first time wey girls dey faint for naija miuzishan for Ivory Coast be dis as one don faint bikos of Psquare some years ago.
Also last year,even tho say na French be dia main language,na so fans for Ivory Coast dey sing along to Wizkid Ojuelegba wen he go play show for dia.



No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...