MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 15 October 2014

WIZKID NA BAD PESIN-SAMKLEF

SAMKLEF and WIZZY in di bigining
Dem say wen dem neva hama, dem go dey loyal but wen dem finally pick, dem no go know u again.
Dis na one yarnings wey u go always hear for pipo mouth concerning pipo wey dey bitray dia frends wen dem don hammer.
Big name producer, Samklef wey dey among di fest set of producers wey make Wizkid blow,don dey yarn dis  kain words about di Holla at your boi singa.
Samklef wey produce about six jams for Wizkid fest album, wit tracks like don't dull and tease me, don yarn say, im be like Wizkid bifor but now he hate even im shadow.But sha o, im say im like Wizkid miuzik and na dia e end bicos di bobo don change and he head don dey swell since he stat to hama.
He say him neva spoil Wizzy name for any wia bifor for good 4 years but Wizzy tell one radio presenter say di rizin why he no dey work witam again na bicos im na schoolboy producer.
WIZKID and AKON
Samklef say di schoolboi beat wey im givam for 'Don't dull' naim Akon wey evribodi know as big name for miuzik, drop im voice put but yet Wizzy say im no sabi.
Na on top twitter he for yarn all dis one and he also say,anytime wey im ask Wizkid, which levels? na so so post he dey postam for good four years.
He say na 250K dem pay am for six tracks wey im arrange for Wizzy and im try to take dat kain small moni for di kain koret beats wey im givam.
Wizkid imsef no waste time to reply all di wicked wicked tins wey Samklef yarn about am and say im dey sorprise say Samklef wey come visitam two weeks ago naim kon dey yarn all dis one?
He say im love Samklef like im blood and im dey pray make God kontiniu to bless im and im family.
.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...