MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 30 October 2014

MANCHESTER UNITED SIGNS CONTRACT WITH CHI LIMITED AS OFFICIAL SOFT DRINK IN NIGERIA




20 times English premier league champions, Manchester United, don sign multi million naira contract wit Chi limited,makers of caprisone, superbite sausage roll and plenti oda product as dia official club soft drink for naija.

Di deal wey reach almost half a billion naira a year,go see Chi limited dey put Man U badge and logo for dia products.
Manchester United fans yakpa for naija and dem even carry di Uefa champions league cup wey dem win for 2008 enta naija.
Players like Robin Van Persie, Angel di Maria, Valencia, Lindegaard attend di ceremony wey shele for dia old Trafford stadium for UK.
During di agreement signing for Old Trafford, di Head of Marketing for Chi limited, Probal Bhattacharya say,Chivita 100% as di main juice for di compini, naim go be di juice of choice for di Man U team.
He say dia compini dey veri proud to dey run tins wit a veri successful club like Manchester United and dem believe say millions of football fans go kontiniu to dey shack di drink wey Man U don approve like Chivita 100% and di rest of dia products.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...