MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 1 November 2014

RICHARD LAWSON,THE BOYFRIEND TO BEYONCE MAMA, TINA KNOWLES, DON ENGAGE HER


Dog meat is a noun, siddon look is a verb.
Ewooo! NA wetin pesin no go hear for life.

6 years ago, if somebodi tell u say Beyonce na prophetess, who go believe?
Wen Beyonce sing dat miuzik for 2008, ''Cause if u liked it, u should have put a ring on it'', no bodi believe say one day na her mama di tin go appun to.
Richard Lawson, di boyfriend to Beyonce mama,Tina Knowles,don put ring for her finger and engage her one time.


Somebodi wey dey veri close to Tina Knowles, naim yarn dis tori come out but we stil dey wait Tina and Richard to confam or deny dis rumors.
60 years old Tina Knowles,don dey date dis her boyfriend for plenti years now since she and Beyonce papa don knock long time ago too.
If dem later confam dis tori, naim be say dis na one marriage wey pipo go talk about wella for years to come.
As we siddon dey wait weda na traditional wedding or white wedding dem go do, make u click and read our next tori.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...