MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 15 November 2014

I DEY BLIND FOR 15 GOOD DAYS-CHIDINMA


Chidinma don soprise many pipo wit her latest jaming jaming wey she call 'Martha', bicos dis time around,she do colabo and feature her mama 'Martha Ekile' for di song.

Season 3 MTN Project Fame winna, Chidinma neva disapoint her fans ever since she win dat competition as she don grow from being just crab apple tree to iroko tree.
Small motor big engine,di name wey i like to dey call Chidinma, don win plenti awards to show for all di hard work wey she don dey do dey come including dat ogbonge KORA awards for di Best female miuzishan for West Africa for 2012.
Di tori now be say Chidinma don come out to yarn for instagram say fear catch her momsie and popsie bicos dem feel say she go be anoda Stevie wonder bicos wen dem born am, she dey blind for 15 good days.
 DIDIER DROGBA NAiM  PRESENT Di KORA AWARDS TO CHIDINMA
Although some new born pikin dem dey take 2 days to 2 weeks bifor dem bigin see but for Chidinma case e be like say dem confamam say she dey totally blind and not di oda way round.
Afta enuff prayers from momsie, popsie and all di well wishers dat time about di eye problem and oda bodi wahala, God kon chuk hand for Martha mata and she kon bigin see veri clear till today.
Somebodi Praaaaaaaaaaaaiseeeeeee da Lord..

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...