MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 6 November 2014

RONALDO HAS OVERTAKEN MESSI-WAYNE ROONEY


Manchester United and England Captain,Wayne Rooney don yarn say Cristiano Ronaldo don ovatake Lionel Messi as di best player for di world.

Wit dis yarns,Ronaldo mind go calm down small against di England captain as im bin don yarn two years ago say,Messi naim be di best player ever.
Di Portuga intanationa,CR7 wey be im forma Manchester United team mate,don dey wicked  and fine form dis season as he don already score 22 goals for 16 matches.
CR7 naim win 2013 Ballon d'Or(World best) and Kai papa,Rooney,believe say na im go stil retain di award.

Rooney yarn all dis one wen MUTV askam weda CR7 go fit win di award dis year again.
Him say Ronaldo don finish work wellwell for di last two to three years and he don ovatake Messi as di best player and he go dey difficult to give anoda pesin di award.
FIFA go announce di winner for January 12 next year for Zurich as dem don already name 23 players including Ronaldo and Messi  wey stand chance to win di award.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...