MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 3 November 2014

NIGERIAN FOLORUNSHO ALAKIJA,9TH RICHEST WOMAN IN THE WORLD


Nigeria bizness woman and billionaire, Folorunsho Alakija name don appear as di numba 9 richest woman for di whole world.
Akordin to di America website, Wealth-X, Folorunsho Alakija wey dey into oil, printing, fashion and oda biznessis, worth 1.2 billion dollars.
Di rumors wey we dey gada now be say, na she be popular Dj exclusive mama even though we still dey wait for confamation.
Wealth-X say dem arrive wit dis list base on di selection of di richest woman for each areas for di world.
For Africa area, na Folorunsho Alakija dust all di rest women including one time richest woman for Africa Isabel Dos Santos from Angola.
To know di top 9richest women for di world, make u check bottom hia:

1.$37.9b Christy Walton North America
2. $31.3b Liliane Bettencourt Europe
3. $14.8b Gina Reinhart Pacific
4. $6.3b Vanessa Paola Slim Latin America
5. $6.3b Soumaya Slem de Romero Latin America
6. $6.3b Johanna Monique Slim Ayub Latin America
7. $.3b Uang Huiyan Asia
8 $4.2b Shari Arison Middle East
9. $1.2b Folorunsho Alakija Africa

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...