MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 5 November 2014

DANGOTE NOW 23RD RICHEST MAN IN THE WORLD

ALIKO DANGOTE
Ahaji Aliko Dangote, di most successful African bizness man, don retain im jersey as di number 23 richest man for di world for di fourth time in a row akordin to forbes magazine.
Naim be di richest black man and also di richest African and he worth 25 billion dollars.
Di Naija bizness man, Dangote, wey dey deal on sugar, cement, cocoa, petrol and oda tings, naim be di first black man to brake enta di 25 richest pipo for di world.
Di owner of Glo telecommunications,Mike Adenuga,naim dey next to Dangote for naija and Africa and he worth 4.6 billion dollars to make am number 325 richest man for di world.
 Africa richest woman, Folorunsho Alakija dey numba 687 wit 2.5 billion dollars and Abdulsamad Rabiu na numba 1,372 and he worth 1.2 billion dollars.
59 year old Bill Gates from America reclaim im jersey as di richest man for di world wit 81.6 billion dollars.
Numba 2 na,Carlos Slim Helu from Mexico, numba 3 na Amancio Ortega from Spain wey get Zara fashion chain.
numba 4 na Warren Buffet from America and he worth 68.7 billion dollars.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...