MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 12 November 2014

DAVIDO LOOSE AGAIN AT SOUL TRAIN AWARDS


All di awards wey O.B.O, Davido don win dis year go don nearly full one drum but he don miss 3 major ones wey he for add join.
Davido,di most successful artiste for 2014 for Naija, don loose again dis time around to  di Trinadad soca music artiste, Machel Montano for di Soul Train Awards wey shele last wikend for Las Vegas.
FUSE ODG
Dis na di third major award wey Davido don lose in 3 weeks as him alongside fellow nominees, Wizkid, Yemi Alade, Dr Sid and Tiwa Savage, lose di best MOBO best African artiste to Fuse ODG of Ghana wey take place on October 22 for SSE Wembley Arena for London.
SAUTI SOL
Also for di Mtv Europe Music Awards wey dem just do, di Kenya group, Sauti Sol difit Davido to win di best African act category.
Although sha 2face win di first edition for 2005,why di koko masta D ' Banj, win di 2007 and 2012 editions of di Mtv Europe Music Awards.
As if dat one neva reach, Machel Montano kon still pam di BET Soul Train Awards for di Best International Performance  last wikend wit im baddest jam,''Ministry of road".
Dis one for hard Davido sha even if Montano no winam bicos of di line up of musicians wey dem nominate.
Oda artiste wey dem choose for dis katigori na,Sam Smith, Nico and Vins, Shaggy, and Ziggy Marley.
MACHEL MONTANO
Machel Montano kontri man, Bunji Garlin, naim also winam last year wit im jam,'Differentology'.
But any wich way, Davido finish work dis year as naim be di most successful Naija and African miuzishan for 2014 as he win plenti beta awards like BET Awards for Best international act Africa,Artiste of di year Mtv Africa music awards, African artiste of di year for Ghana music awards and many oda ogbonge awards. 

1 comment:

  1. Eyaaa but he still remains a big boy

    www.jaybossng.com

    ReplyDelete

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...