MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 8 November 2014

WHY I LEFT POLICE FOR FARMING-EX AIG, IDRIS HADEJIA MUAZU


Di forma Assistant inspector General of Police,retired Alhaji Mua'zu Idris Hadejia, don yarn one of di rizin why he retire from police.
He say agriculture is life and na farming tins getam now since he get take care of him family.
He say farming na wetin nobodi sopose to joke wit since e go provide fresh food for yor table.
Hadejia say him come from a big family, so since 1+1=2, naim make di family join head togeda to take dis farming bizness sirios.

He say as di Head of di family na sense him get use to run tins.
Di ex-AIG, say, him also dey into comercial farming but di most impotant tin na to get enuff to feed him family first and then oda Nigerians.
He say if evribodi dey do like dis, naim be say Nigeria go beta for all of us.
For example, Hadejia say di rice wey im dey eat for house and di one wey im family for Hadejia, Jigawa State dey eat, all na from di farm.he say dem get enuff yam too, beans, corn, cassava, soya beans, okro and plenti oda food to eat and to sell.
Him say dis farming no be today mata as him lenam from im popsi and momsi dem.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...