MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 5 November 2014

JADEN SMITH TO REMOVE HIS PENIS ON 18TH BIRTHDAY


All di yong girls wey dey die for Jaden, di pikin of actor and musician Will Smith,una sorry oo bicos di bobo don change im mind concerning im third leg.
16 year old Jaden,di older broda of pop star,Willow Smith,don make one kain rugged announcement concerning im John Thomas.
He don dey make plans for im 18 year birthday for 2016 and di plan sef go shock devil imsef.
Jaden Smith yarn say,he go remove im Penis and im hope say dat one no go stop im popsie and momsie to dey take care of am especially to dey giam money.
He say im John thomas no define who im be.he say im no be homo, im just won be dat boi witout penis wey dem dey call Jaden.
JADEN and im PAPA
He say dis kain decision no add or reduce from di man wey im be like im male fans.
Jaden say forget say im na actor like im papa,Will Smith,he say he no need di penis bitwin im legs to be di karate kid wey dem know am for.
Na wa o., dis one no be small tin o.
Una sure say im no go change im mind afta?

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...