MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 1 November 2014

BOKO HARAM SAY DEM HATE NEGOTIATIONS, MAKE DI WORLD EXPECT MORE KILLINGS



Boko Haram ogakpatakpata, Abubakar Shekau wey di millitary claim say don die,don reliz anoda video yestaday wia im for yarn im mind.
Na hausa language di guy take yarn evri.

Shekau say make govment stop to waste dia time say all di ova 200 chibok girls wey dem kidnap don turn moslems finish.
He say even kpakpa sef, all im bois don marry all di gehs.
Shekau say di man, Danladi Ahmadu wey dem say he dey represent Boko Haram for di join bodi meeting wey dem dey do wit govment for Chad on how dem go take reliz di girls, na imsef and im family he dey represent.

He say dem no know am and he say by di way, wetin dem won follow govment dey discuss for wen Allah say make dem no follow anybodi negotiate?
 Shekau say na heavy lie if anybodi yarn u say dem dey negotiate wit any baga.
Pesin wey carry di mata for head like lakpalakpa na Chief of Defence Staff, Air Marshal Alex Badeh wey dey yarn say govment don enta agreement wit Boko Haram say make dem take brake for fighting.
Shekau say Alex Badeh no know wia dey pain am as Boko Haram no do any agreement wit anybodi.
Infact Alex Badeh hometown of Vintim don turn victim as Boko Haram don capture di town yestaday As dia own.
 As we dey yarn so, Shekau say dem don kidnap one Germany man wey dem say na tisha for one technical training centre for Gombi wey dey about 100 kilometres away from Yola, di Adamawa state capital.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...