MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 17 November 2014

"SHOKI" LAND OREZI IN TROUBLE FOR REDEEM UNIVERSITY


Delta state and Isoko pikin,Orezi eyes see Nwhi for Redeemers Univasiti wen he go sing for di school show wey dia SUG  organize to welcome fresh student.
Evritin be dey go on veri fine as di students don dey dance and scata dia dada until Orezi wey sing dat ogbonge music 'Rihanna',go misyarn and stat to dey sing dat he jam"Shoki" and shoki get veri bad meaning for yoruba..go ask omò o'dua dem.
Imidiately di show enta gear 8,naim Orezi head turn.
As he just yarn di crowd say,oya dance shoki!dance shoki!

naim di oga wey dey look afta di students so dat dem no go dey misbehave and dance disco for skul anyhow,shout for Orezi say,
"stop it!!you no know say na christian school be dis? Oya Mr Dj stop di music or I go stop you!u Orezi,bigin waka,yor time is up!
Na so Orezi dey disaponted and carry im bag and remove from di school with im friends.
But sha,di students protest tire but all di protest na deaf ears dem enta.
Orezi later yarn for twitter dat day say di groove just enta gear 9 bifor dem fall dia hand.he also apologize to di student say make dem no vex,say next time dey.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...