MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 4 November 2014

I WILL DEFEAT GOODLUCK JONATHAN WITHOUT SWEAT-ROCHAS OKOROCHA



Di Govnor of Imo state, Mr Rochas Okorocha don say make anybodi no doubt am bicos im go defeat President Ebele Jonathan for di 2015 presidential election hands down if dem givam chance.
He yarn dis one for di rally wey one group for north, Arewa Pipos Grand Coalition organize foram for Kaduna to convince am to contest di 2015 presidential election.
He say among evribodi like Atiku Abubakar, Buhari, Kwankwanso wey won contest unda All Progressives Congress,APC, nobodi wey dat Aso Rock chair go fit reach am.
 Okorocha say among all of dem wey dey say dem won be President, none of dem done provide free education for any state or any part of di kontri bifor.He say na only him done provide free education for im state and for some part of di kontri.
He say if naija pipo make am presido, naim be say pipo go enjoy free education and free evri,o.va and ova again.
Bifor di join bodi rally, Okorocha don carry waka go meet di Emir of Zazzau, Alhaji Shehu Idris and lay di foundation of Rochas Secondary school for di area and he say wen di skul stat, na free e go be.
Govnor Okorocha wey sabi speak Hausa language veri well no dissapoint di crowd bicos na di language and English he take break all di yarnings down.
Di govnor say di only problem wey APC get na to pick di pesin wey go veri hard and difficult for PDP to defeat.
He say, make dem pickam bicos naim be di only pesin wey go bring victory to APC and him go  win Jona without any sweat.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...