MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 9 November 2014

BELGIUM CHOCOLATE MAKER CHANGE NAME FROM ISIS TO LIBEERT BICOS OF TERRORISTS



If di group, Islamic state for Iraq and Syria, ISIS, neva win dia fight against dia govment yet, at least dem don win one kondo against Belgium chocolate compini, ISIS, wey dey bear di same name wit dem.
Since dis group come out, di chocolate compini bizness kon fall bicos pipo sef tire to chop di chocolate.
Di compini wey don dey exist since 1923,change dia name from Italo Suisse last year bicos dem no get any real bizness wit Switzerland and Italy again and now di terrorists group don make dem get change of mind again bicos of clash of  names.

Now di new name wey dem won bear now, na "LIBEERT" di family name of di compini owners and I hope say notin go make dem change am dis time around again.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...