MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 12 November 2014

PASTOR GIVE 11 YEAR OLD GIRL BELLE FOR IJU ISHAGA


No be small drama and soprise for di senior magistrate court for Abule Egba area for Lagos yestaday as dem judge di case of one pastor wey give one 11 years old geh belle.
Di pastor church dey for Odunbaku strit for Iju Ishaga,Agege and im name and di geh name still dey sikrit for now.

Di Girl mama and di rest children move from dia house go stay church wen di man tell di mama say he dey see death for dia house.
Make she go solve her problem for church naim pastor kon dasham more ogbonge problem.
Di mama say she notice say her pikin dey complain of belle pain evri time and dey show malaria sign.
Dia nurse kon trit her for malaria but afta sometime di sickness still kontiniu and dat one kon make dem do scan for her.
Di result of di test show say di smallie dey two months pregnant, Yekpa!
Wen dem put pressure on di geh to yarn how e take appun, she say, di pastor giam holy water to drink and one red tin to rub for her face and imidiately she rubam,naim eye turn am.
Bifor she know wetin  dey appun, Pastor don dey on topam.

As she say make she shout,Pastor rush cover her mouth and tell her say,she go die if she tell anybodi.
Di 32 year old pastor wey dem charge for two tings, raping and belle giving, later tell di court say im no do any wrong.
Di lawyer wey dey judge di case,Mr T.A. Elias, say make dem stil kip di pastor for cell make im celebrate Christmas for dia and make moskito stil bite am small till January 15 afta dem don take di advice from di Directorate of Public Prosecution on wetin dem go do.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...