MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 2 November 2014

MAMA REJECT N400,000 NAIRA TO GIVE HER PRIMARY 6 DAUGHTER OUT FOR MARRIAGE

BABIRYE KASUUBO
A 37 year old woman, Babirye Kasuubo from eastern Uganda na di talk of di town afta she reject sh602,000 Uganda shillings about 400,000 Naira from one man wey won marry her daughter wey dey primary 6.
Infact village drunkards especially, don dey laugh her and call her"foolish woman" sake of say she reject di moni.
Kasuubo despite di fact say she poor finish, reject di raba bicos she want make her pikin go school and grow up to bicom responsible pesin.
Kasuubo wey come from Kiige village, Balawoli for Kamuli, don dey single since she separate from her husband, Richard Basoga 12 years ago and na corn and beans wey she dey grow for farm dey survive her.
Di mata appun wen di guy,25 years old John Odongo wey be fisherman, waylay her dota on her way back from skul and force envelope put for di pikin skul bag and tell her say, e contain "veri sweet message" for her mama.
As di geh rich house, she give her mama di envelope.di mama carry di envelope straight to her pikin headmaster, Mr Joab Kyalo of Kiige Primary school and dem see 400K for inside wen dem open am.
John Odongo sign for di letter sef and na im friend,Julius Opolot hepam write di letter.
Odongo papa also sign for di letter as witness.
For Kisoga culture, anybodi wey won be son-in law, go write letter inside envelop and put moni starting from sh200,000 and above.
Once dem accept wetin dey di envelop,dem go kon arrangement for di traditional marriage.
But for Odongo case, sh 600,000(N380,000) na for di geh papa and mama, why sh2,000 na for pesin wey read di letter to dem.
Di HEADMASTER,JOAB KYALO
Di headmaster wey know say na di geh life dis boy won destroy for ground no waste time as he report di mata to Balawoli police station so dat dem go deal wit Odongo.
As we dey talk so, Odongo don take yawa race comot for bunk as he hia say police dey find am.but im papa, Vono and friend Opolot na dem kon use head carry am as police don arrest dem and detain dem for Kamuli Central police station.
Di headmaster explain say as di Head of di school, im duty na to make sure say di shidren finish and complete dia primary 7 bicos of late so so belle naim di gehs dem dey carry.
KIIGE PRIMARY SCHOOL
He say for 2012, im stop one traditional marriage ceremony for one primary 7 geh wey dem come pick from classroom to go marry.
He also yarn say for di same year, 3 gehs marry why 2 odas write dia Primary Leaving Examination ( PLE) wit pregnancy.
For 2013, he say na 7 girls get belle.
Di headmaster, Kyalo say dis year,2 girls for primary 6 don get alreadi belle and he say e dey veri embarrassing bicos dem celebrate "Di International Day of Di Girl Pikin" for Kamuli just last week.
Meanwhy, di mata of di geh won dem won marry don tie new wrapper bicos since police reliz Vono and Opolot on bail, dem don twist di mata and open dia own fresh case say, di geh mama, Kasuubo, na tiff she tiff dia money no be for any marriage.
We go dey wait to hear how di mata go end.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...